Di Director-General for di Nigeria Centre for Disease Control, Dr. Ifedayo Adetifa don bet say coro fit increase for Naija as we dey enter holiday season because plenty people dey travel for holiday.
Adetifa yan say dem dey ready and di coro vaccination wey people don collect go help shield dem small.
He also yan say Omicron variant of coro still standa strong for di country.