Di conference of Parties on Climate Change wey dem dey call COP 27 been start on Sunday for Sharm El Sheikh, Egypt, and more than 50,000 delegates don register for di annual global summit where dem go ok about how to dodge climate palava.
Di event go end on November 18th and na di second time dem dey do am for Africa after di first one dem do for Morocco for 2001.
Di UN Climate Change Executive Secretary, Simon Stiell, point out say COP27 set out new direction for implementation so that result wey come from di formal and informal process go help better di climate change progress.
Di UN Climate Change executive secretary beg governments make dem first of all implement di Paris Agreement and also start to dey do wetin dem tok.
(NAN)