One Professor for Public Health, Tanimola Akande don yan say Naija people suppose collect vaccine wey go protect them against respiratory infections wey dey common for dry season.
Professor Akande point out say respiratory diseases dey very common especially for pikin dem during dry season so nĂ¡ only vaccine go fit save them from those kain infections.
Di health expert note say for dry season, respiratory diseases like rhinitis, bronchitis and pneumonia dey plenty like fly and if pikin dem get dem and no treat dem well, e go cause serious health palava.
Mayo Clinic wey be medical center wey dey shine light on integrated health care, education, and research, yan say pneumonia fut affect anybody but na pikin dem we dey under 2 and people wey don pass 65 dey suffer am pass.
If dem no treat am well, e fit cause sepsis, bacteria in the bloodstream, difficulty breathing and fluid accumulation around di lungs.
Prof. Akande also yan say no be only vaccination but make people avoid area wey dey dusty and make sure say dem use face mask, drink plenty water and dey use moisturising cream go help well well.