Home As e de hot Cholera dey chop Malawi like food!

Cholera dey chop Malawi like food!

177
0

Malawi don collect 2.9 million Oral Cholera vaccine on Tuesday.

Di outbreak wey just happen since March don kpai more than 200 people for di country.

Statement wey WHO, UNICEF and Malawi government release tok say dem collect di OCV package on Monday and na very critical time because di country still dey try fight di Cholera and na Gavi, the Global Alliance of Vaccines dey fund am.

Di statement yan say na WHO, the Malawi government through the Ministry of Health, and UNICEF dey run di support so di Global Emergency Stockpile go fit deliver am.

E still tok say di Malawian minister of health, Khumbize Kandodo Chiponda yan say di campaign go target 2.9 million Malawi people both adult and pikin from 1 year wey dey live for affected areas.

Dem don report di outbreak for 28 districts inside di country but na only 14 districts dem go focus di OCV doses for as dem get too much cases and di districts na Chitipa, Karonga, Rumphi, Mzimba, Likoma Island, and Nkhata Bay up north; Lilongwe, Salima, Nkhotakota, and Kasungu in the central region; Nsanje, Zomba, and Blantyre for di southern region.

Malawi don record 7,030 cholera cases and 207 people don kpai from cholera, 6,608 don recover and 215 people still dey recover as of Monday, November 7.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.