Cancer experts dem don yan say some kain job fit increase risk wey person get yo carry cancer because dem dey always dey open to things wey dey carry cancer come.
Di experts yan say say apart from people wey dey smoke like pipe, people wey dey pack rocks, people wey dey into mining, and carpentry dey for di frontline of people wey fit get cancer quick quick because of harmful chemicals and wood dust wey dey enter dia body on a daily.
Di oncologist wey be Consultant Radiation and Clinical Oncologist for di Jos University Teaching Hospital, Jos, Plateau State, Dr. Samuel Kwis, yan say people wey dey into fat kain work suppose dey do health checkup every time.
Dr. Kwis yan say lung cancer na one of di deadliest forms of cancer because e dey pass early stage without symptoms and na people wey dey exposed to carcinogenic and radioactive substances fit get am more.
Di oncologist yan say di early stage of di lung cancer dey asymptomatic.