Specialists for maternal health don warn women wey get belle make dem no dey sleep for dia back after dia first trimester because dat kain position fit Scatter di veins wey dey supply blood to di organs of di body, come still get serious effects for di woman.
Di experts reveal say di position dey very uncomfortable and e fit lead to shortage of blood to di heart, brains and even to di baby too especially if di woman stay for sat position for long.
Di physicians come still point out say di best position for women wey get belle during second and third trimester to sleep na for di left side so di weight of di womb and di baby no go dey press on di blood vessels.
Associate Professor and Consultant Obstetrician and Gynaecologist for di University of Nigeria Teaching Hospital, Ituku/Ozalla, Enugu State, Dr. Uche Agu tok say e dey very important make women no dey sleep face up because she fit get fainting attack because major veins wey dey supply blood to di heart and brain dey collapse.
Agu tok say di poor blood supply fit make di woman dizzy, sweaty and make her like say she wan vomit but den e no dey permanent.
.
(Punch Healthwise)