Di Ozara people inside Oru West local government Area for Imo State don dey ask questions about where di 4.5million Naira Primary Healthcare Development fund wey día governor, Hope Uzodinma, been release dey.
Ever since coro hit di world, e dey obvious say health sector for naija no dey work well and di Imo State Governor, Hope Uzodinma, bring out money to better primary Healthcare centre for di state.
For November 2021, di governor been release 4.5 million naira make dem use bring back healthcentres wey don die for di 305 wards wey dey di state.
The problem come be say nobody know where the money wey di governor bring out for di PHCs dey and Ozara Healthcare centres don scatter, rotten kpata kpata.
As di healthcentres dey very bad like dis, ozara people just dey suffer anyhow for health because dem no get medical services wey go help dem.