Di WHO and UNICEF don twale for di funding agreements wey King Salman Humanitarian Aid and Relief Centre dey provide to bolster polio and measles programmes in eight countries and e worth 10 million dollars.
Di WHO for dia statement on Monday say dem sign di agreement for di sidelines of di World Health Summit for Berlin and di finding go give WHO and UNICEF 5 million dollars each so dem go block polio and measles epidemic.
Na King Salman bin Abdulaziz been establish KSRelief was for 2015 so dem go support Saudi Arabia to help people wey need help for di world.
WHO tok say dem go support polio and measles programmes for Somalia, Iraq, and Sudan.
UN say dia own na to get lab equipment, enhance surveillance, digitalise di Essential Programme on Immunisation, strengthen the cold chain;and train campaign vaccinators.
UNICEF yan say dem go support di five high-risk countries of Afghanistan, Central African Republic, the Democratic Republic of the Congo, Guinea, and Pakistan.
.
(NAN)