Home As e de hot We go eliminate maternal mortality kpata kpata – UNPFA

We go eliminate maternal mortality kpata kpata – UNPFA

100
0

Di United Nations Population Fund dey work with Kaduna State stakeholders make dem comot kpata kpata di maternal and perinatal mortality wey dem fit prevent for community level.

Di State Implementing Partner for UNFPA Projects for di Planning and Budget Commission, Mr. Shinkut Sheyin, yan dis one on Tuesday for interview and he say dem dey run dis mata through scale-up of the Community Maternal, Perinatal Death Surveillance and Response (cMPDSR) model for di state.

He yan say as community dey get involved for MPDSR, na part of di Fund’s Behavioral Change Communication programme and e dey help increase access wey dem get to sexual and reproductive health information and services by women, adolescents, and youths who on a normal dey always dey behind.

He add say di community dey meet every monthly make dem tok about factors wey dey cause maternal and perinatal deaths and to promote institutional delivery through verbal autopsy.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.