United Nations Population Fund don reveal say dem go continue to dey give reproductive health services for people for Borno state as di state government still dey resettle people wey dey displaced.
Di Humanitarian Coordinator and Head of the Maiduguri Office for UNFPA, Mr. Macauley Christian, yan say dia agency still dey gidigba to dey help people wey dey displaced for camps.
Christian add say di One Stop Centre wey di agency build for Maiduguri go continue to dey support and provide multi-sectoral GBV services like mental health, psychosocial support, technical management of rape, and medical care for GBV survivors.
Him yan say UNFPA dey also put eye for safety and security as dem go arrange legal practitioners and para-military wey go see say survivors get justice.
He still explain say just for dis year, di agency don sensitise 324,219 community members for reproductive health and GBV.
NAN report show say UNFPA na United Nations sexual and reproductive health agency wey him mission na to make di world a place where every belle dey wanted, every delivery dey safe and potential of every young person go dey satisfied.
.
(NAN)