Home As e de hot We go comot bottlenecks wey dey stop nutrition progress – Kaduna State

We go comot bottlenecks wey dey stop nutrition progress – Kaduna State

186
0

Kaduna State Government dey work with partners for development and other stakeholders make dem fit settle di roadblocks wey dey slow down nutrition mata for di Local Government Areas.

Malam Bashir Muhammad wey be di Permanent Secretary, Planning and Budget Commission for di state been yan dis one for Zaria on Saturday for di second-quarter coordination and review meeting wey dem get with Local Government Nutrition Focal Persons.

Di News Agency of Nigeria report say United Nations Children’s Fund been support PBC to organize di meeting.

Muhammad wey also be di Chairmo for di state committee for Food and Nutrition point out say government and development partners wey dey support dem go start high-impact and cost-effective nutrition programmes for communities for di LGAs but one big roadblock wey dem dey get na access to di funds wey don dey allocated to dem already.

He reveal say some of dia development partners na UNICEF, Accelerating Nutrition Result in Nigeria, Alive and Thrive, Civil Society-Scaling Up Nutrition in Nigeria, Nutrition Society of Nigeria, and Save the Children International, and plenty others.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.