Di Nigeria Centre for Disease Control don yan say dem dey do sharp sharp assessment so dem go fit guide di country incase Ebola strike as e don land for Uganda.
Dem been yan dis one inside press release wey di Director General of NCDC, Dr. Ifedayo Adetifa sign and dem say risk plenty if Ebola jam naija, both on the people and economy.
Di agency still calm naija people down say dem never get any Ebola case and all di agency dey ready to fight am if e come.
Di outbreak wey Uganda dey suffer na because of Sudan Strain of Ebola wey dem announce on 20th September 2022 and the World Health Organisation confam am.
Na di Sudan strain for di Ebola virus dey cause EVD and e don strike before for Uganda, South Sudan, and the Democratic Republic of Congo.