Di National Commission for Persons wey get Disabilities don reveal say e go spend N10 million for fight against cancer for people wey get Albinism.
Di Executive Secretary of NCPWD, Mr. James Lalu, yan dis one wen Jake Epelle wey be di Chief Executive Officer for Albino Foundation and him management team been visit di commission inside Abuja.
Lalu been present copy of 2022 to 2026 strategic plan document wey him get to di Foundation come tok say di commission go make sure say di country include people wey get disabilities inside things wey dem dey do for areas of national development.
Lalu still come tell di Foundation say dem dey ready to go through with their partnership and collabo as him bring Memorandum of Understanding (MOU) especially for informate wey dem go dey share to help dem plan well.
He still say well don to di Albino Foundation for di five strands of the European Union Disability Inclusion Project wey e dey do and him tok say di project na style wey dem dey use to show political people say people wey get disability fit follow for wetin di system dey do.
Lalu come open up say di commission dey work to see say di sign language wey dem dey do enter as national sign language and make dem also expand di sign language dictionary.
Jake Epelle wey be di CEO of Albino foundation come tok him own say dem dey do dis project make so e go dey more inclusive, and dem go fit get rep for naija.
Epelle tok say di Foundation wan collabo with di commission for di project and make dem understand say di Albino Foundation na di face of disability for inside European Union.
.
(NAN)