Di Nigeria Centre for Disease Control don announce say suspected cases of cholera don reach 10,745 as 256 don kpai from am dis year alone.
NCDC been reveal dis one for dia Cholera Situation weekly epidemiological report wey dey drop for week 39 for dia official website on Tuesday.
Di report show say 31 states wey be Abia, Adamawa, Akwa Ibom, Anambra, Bauchi, Bayelsa, Benue, Borno, Cross River, Delta, Ekiti, Gombe, Imo, Jigawa, Kaduna, Kano, Katsina, Kebbi, Kwara, Lagos, Nasarawa, Niger, Ondo, Osun, Oyo, Plateau, Rivers, Sokoto, Taraba, Yobe and Zamfara don report cases dem dey suspect so far for 2022.
Cholera dey mostly occur for naija during rainy season especially for areas wey no get better sanitation.
Di report wey come from 9 states dey show say Naija get 4,153 cases dem dey suspect and for inside – Borno (2626), Yobe (718), Gombe (317), Zamfara (212), Bauchi (119), Jigawa (95), Sokoto (47), Katsina (16) and Adamawa (3).