One health expert, Dr. Toluwani Binutu don warn make naija people no dey too take plenty vitamin C because e fit cause kidney problem especially for men.
Binutu wey dey work for UK yan say some people dey chop vitamin C like say na sweet especially di orange one because say di taste nice.
He reveal say e no good at all because research don show say men fit double risk to get di most common type of kidney stone dem dey call calcium oxalate stones and e fit lead to complications like kidney failure to bladder blockage to life-threatening blood poisoning.
He point out say di average man go need 90 mg of vitamin C daily and di average woman go need 75 mg daily, make e no pass like that.
.
(Punch Healthwise)