Home As e de hot UTI fit dey show say you get prostrate! No ignore am! –...

UTI fit dey show say you get prostrate! No ignore am! – Experts to men

233
0

Experts wey dey treat conditions wey dey affect urinary tract for both men and women don warn make men no dey overlook constant urinary tract infections and fevers because dey fit be sign is serious health palava for dia prostrate.

Di urologists come explain say if fever, weight loss, or urinary infections, dey occur steady especially for middle-aged men, e fit be signs of prostrate disease.

One of di experts, Consultant Urologist, Dr. Gabriel Ogah come warn say make men no dey ignore dis kain palava but make dem go see urologist sharp sharp.

He explain say if dem go hospital on time, chance of cure fit dey but if dem bring am late, na palliative care dem fit manage.

Di other expert, Consultant Urologist, Dr. Ahuizechukwu Obiesie come explain say 2 main palava wey dey hold man for prostrate na benign prostatic enlargement and prostate cancer.

He explain say if man get benign prostatic enlargement, e mean say him prostrate fit enlarge and cancer no go dey am but if him get prostate cancer, e mean say di prostrate go go through some malignant transformation wey fit dey very dangerous if dem no treat am on time.

Obiesie come point out say many naija men dey get benign prostatic enlargement.

Di experts come tell dem make dem avoid anything wey go cause infection for dia urinary tract so dem go fit reduce risk of prostrate.

Dey also beg make men avoid sexually transmitted disease and also avoid smoking.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.