Di Civil Society Legislative Advocacy Centre don beg make federal and state governments increase money for rates wey dey on top tobacco and him family because e go bring more money for government and also cut down on how people dey take tobacco.
CISLAC say na because tobacco dey cheap and affordable make people dey use am anyhow, so make government do something sharp sharp.
Di group been yan dis one for dia stakeholders’ meeting on Tobacco Taxation and Resource Mobilisation wey dem do inside Gombe and dem say make government bring out policies wey go control how people dey use tobacco.
Di Programme Officer of Democratic Governance for CISLAC, Solomon Adoga, reveal say people dey kpai because of tobacco and now dey need to dey see am as problem for public health.
Executive Director for CISLAC, Auwal Ibrahim-Musa wey send him represent Mohammed Muritala yan for him side say dis mata don start for national level since 2015 and dem dey try now to make Gombe people understand how bad tobacco dey both on health and money.
Di Executive Director still point out say dia meeting na to improve the capacity of stakeholders so dem go fit fight di abuse with good policy.