Home As e de hot Relief materials don dey for people wey cholera affect – Gombe State

Relief materials don dey for people wey cholera affect – Gombe State

191
0

Di Gombe State Government don collect relief materials from National Emergency Management Agency di people wey survive cholera for di state.

Dem give di materials to di Government for di Primary Health Care Centre, Tudun-Wada, Gombe, when dem dey do ceremony and na Deputy Governor, Dr. Manassah Jatau, represent Governor Muhammadu Yahaya.

Di Governor collect di items come make presentation to some people wey don survive cholera and still direct make di right authorities dey sure say di items reach people wey need am.

Gov. Yahaya just before di presentation twale for di Federal Government of Nigeria and di National Emergency Management Agency say dem really come through for people wey cholera affect.

Di Represent of di Director-General National Emergency Management Agency, Mustapha Ahmed, yan say dem bring di items so dem go fit reduce suffering for di people wey cholera don affect for di country and di items wey dem bring na 39 cartons each of Dettol, Izal, and bleach, 800 packets of detergents, and 1000 pieces each of blankets, mattresses, plastic buckets, spoons, and pieces of mosquito nets plus others.

He still beg make di officials make sure say dem share di items to di right people.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.