Home As e de hot Put money for medical research – AMSN

Put money for medical research – AMSN

63
0

Di Academy of Medicine Specialities of Nigeria don beg make government dey put money for medical research.

Di Presido for di association, Dr. Oladapo Ashiru, yan say funding dey very importankpa so medical sector go dey grow in any country and as government no dey fit carry am alone, make private individuals come put body too to help medical research.

Ashiru been yan dis one inside press briefing wey dem dey get just before di second Annual General Meeting, Scientific Conference and Convocation of di association wey dem suppose get for 29th October for di Sheraton Hotels and Towers, Ikeja.

Di Academy of Medicine Specialties of Nigeria na non-profit Organisation wey dey give advice for medical matters, education and research, medical care and public health and dem get 135 fellows wey be professors and academicians from different medical specialties.

Dem get 5 quality researchers wey dem go soon induct as new fellows: Prof O.C Ezechi, Prof. C.O Eregie, Prof. A.E Akinwutan, Prof. Azeez Butali and Prof. F.J Owotadw.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.