Associate Professor and Consultant Obstetrician and Gynaecologist for di University of Nigeria Teaching Hospital, Ituku/Ozalla, Enugu State wey be Dr. Uche Agu don warn make women no dey depend on the pullout method for birth control because e no dey reliable to control belle.
He tok say di method get very high failure rate and make couples no dey depend on am because even tho e dey work for some people, e get plenty fault and e no dey too work.
One article wey Mayo Clinic publish say na one out of five couple wey use pull out method go carry belle because e no dey as strong as other way wey dey prevent belle.
Dr. Agu still point out say men dey lose control once it get to di point of orgasm when e dey sweet dem and before dem know, dem don release inside di woman before dem remember to pull out. And even di ones wey still get control for don drop some vbefre dem comot am.
Data from World Health Organisation website for 2020 yan say even if dem do am very well, four percent of people wey dey use pull out method dey always get belle and e just dey like condom wey, even if you use am 100 percent well,two percent still get chance to get belle.