Home As e de hot Provide free sanitary pads for young girls – Bauchi student

Provide free sanitary pads for young girls – Bauchi student

111
0

Ms. Umma Bala wey be student for Bauchi, on Wednesday, beg make di Bauchi State government and other stakeholders share free sanitary pads for young girls.

She make dis request for herself and her age mates for di one-day dialogue session for problem wey dey bother di girl child wey NGO, Plan International Nigeria, organise say, e dey necessary so young girls go fit know dia potential.

Di report from News Agency of Nigeria tok say di event na to mark di 2022 International Day of the Girl Child and di title for di dialogue na “Equal power in leadership, decision-making and political participation for girls.’’

Umma come tok say most girls no sabi anything when e reach self-care when dem dey dia period, so make Reproductive health education dey for di curriculum for schools in Bauchi.

Mr. Nasiru Musa wey be Senior Programme Coordinator, Plan International Nigeria, reveal say di NGO plan to gather 10 million naija girls for programme wey dem title: “Strive, Decide, Lead and Learn’’ and dem go do am in five years from 2022.

Executive Secretary of Bauchi State Primary Healthcare Development Agency, Dr. Rilwanu Mohammed, say him dey happy say stakeholders for different sectors dey put eye for dis mata and di state don dey introduce health interventions for adolescents and youths.

One represent for UNFPA wey come di session, Ms. Deborah Tabara, say as dem dey teach girls make dem no leave boy out in menstrual education.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.