Experts wey dey see for childcare don debunk di rumour wey say women wey get belle no suppose breastfeed dia pikin because e go cause sickness to either the mother or the baby but dem say make women no dey fear to breastfeed dia pikin when dem get belle.
Di experts say science no back that rumour up and na only strong mental help di women need so dem go fit do di two things well.
Di expert wey be Consultant Paediatrician for di Nnamdi Azikiwe University Teaching Hospital, Nnewi, Dr. Chisom Ulasi, tok say even tho di pikin or mama no go fall sick when she dey breastfeed, wetin go happen be say di mama fit use all her energy for di baby wey she don born already so she go just tire and na why she gats take a lot of calories make she no suffer.
Di paediatrician still tok say make di women make sure say she avoid anything wey go stress am because she need to dey mentally strong as di breastmilk for stop or di baby for womb go suffer small, so make she no stress herself at all.
Ulasi come add say make di women make sure say dem take enough calcium wey doctor go tell am as e dey very important for di baby wey dey belle and di one she dey give breast.
She still yan say most times wey pregnant women no take enough calcium, di body go just take di one wey done already dey di body, so na why some women wey just give birth dey get holes for teeth.
Ulasi come beg make mama dem dey take plenty food wey get calcium like yoghurts, eggs, milk, and cheese.