Home As e de hot No dey give children adult drug even if na half! – Experts

No dey give children adult drug even if na half! – Experts

168
0

Experts for pikin health don dey warn parents make dem no dey give pikin dem half of adult dose of drugs when dem dey sick becauss e fit harm the pikin.

Dey tok say e dey importankpa say na professionals dey prescribe drugs wey pikin dem dey take because dem fit get problem if dey start to dey take wrong medication.

Di expert wey be Professor of Paediatrics for di Department of Paediatrics, College of Health Sciences, University of Ilorin, Kwara State, Olugbenga Mokuolu, yan say even tho di act dey common for naija, e dey very wrong and parents need to stop am make dem no carry dia hand bring problem for dia pikin.

Prof. Mokuolu wey be also Consultant Paediatrician for di University of Ilorin Teaching Hospital reveal say age na very serious factor to consider when parents dey give dia pikin drugs and make dem make sure say dey follow instructions wey health person give when di pikin dey sick and no be to do self medication.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.