One new study don show say if women wey get belle dey chop plenty junk food, e dey very possible say dia pikin go dey obese when dem born am.
Di study tok say ultra-processed foods like cakes, biscuits, ice creams, etc, get different additives like stabilizers, artificial flavours, and artificial colours, and contain little, if e dey at all, whole food ingredients.
Dey also tok say ultra-processed foods get more sugar, sodium, and saturated fat content if you compare am to di food wey no too dey process and even evidence don link ultra-processed food to excess body fat, overweight, and obesity for adults and children.
Di researchers yan say as maternal diet fit get influence for di weight and size of di pikin, e dey important say pregnant women dem go dey dey careful on wetin dem dey chop.