Experts for health beg make naija people no dey chop animals wey die on him own because e fit cause serious health palava and e fit still make people carry, come spread zoonotic diseases to other people.
Di experts come warn make naija people know where dem dey buy día meat to chop because some market people or even restaurants fit dey sell di ones wey die on dia own to people wey no know, so make dem also know where dem dey buy food because cooking fit no destroy any poison wey go dey inside di animal.
Di experts wey be a professor of Public Health, Dr. Tanimola Akande, and veterinary doctor, Chidozie George, yan say no be because of religion dem no dey gree make people chop animal wey die on him own but na because of Health palava e dey cause.
Prof. Akande point out say when di animals die, dem no dey get any circulation wey dey maintain tissues, muscles and organs and e dey increase chance for germs to be toxic because regulation no dey again.
Di veterinary expert, Dr. Chidozie George reveal say even if dem grill or boil di meat, di poison wey kpai di animal no go go.
He warn farm people make dem no dey sell dead animals to naija people because person fit come carry di poison wey kill di animal wey him chop.
He come beg make veterinarians and environmental health officials make sure say people no dey sell animals wey don kpai so di country fit dey avoid zoonotic diseases and other infections wey fit come from am.
.
(Punch Healthwise)