Home As e de hot Nigeria at 62: Healthcare don better for my govt – Buhari

Nigeria at 62: Healthcare don better for my govt – Buhari

192
0

Naija Presido, Major General Muhammadu Buhari (retd.) on Saturday been yan say him government don make health facilities and Healthcare better especially when and after coro been attack and him yan dis one even tho say medical people dey japa every second from di country.

As dis na him last independa address to naija people as Presido, Buhari yan say him government still dey committed to comot 100 million naija people from poverty in 10 years.

Meanwhile as Buhari dey twale for himself for healthcare sector wey him improve, di Nigeria Association of Resident Doctors dey reveal say 6 out of 10 doctors for di country dey plan japa to find better place.

Di Publicity Secretary for NARD, Dr. Alfa Yusuf, cone point out say di brain drain dey get worse everyday and soon, naija fit dey begin look for doctors from other places.

Data wey General Medical Council for di United Kingdom drop come also dey show say more than 6,068 medical doctors don japa to di United Kingdom since Buhari enter seat for 2015. E show say Naija doctors wey don japa to di UK na 10,096 as of August 30, 2022.

Right now, na naija get di highest number of foreign doctors wey dey work for UK, after India and Pakistan.

Di independa speech wey di Presido, Buhari drop, dey here:

“Fellow Nigerians, we have also improved our health facilities, especially during and after the outbreak of the COVID-19 pandemic, which attracted commendation from the global community.

“As you are aware, Nigeria was one of the countries that defied global predictions of the socio-economic impacts of the COVID-19 pandemic because of our resilience, commitment, and passion with which we individually and collectively managed the pandemic.

“I share the pains Nigerians are going through and I assure you that your resilience and patience would not be in vain as this administration continues to reposition.

“It is in this spirit that I call on all of us to individually and collectively bring to the fore in dealing with all our development issues.

“I was called to serve, and along with my team, I saw an opportunity to create a better Nigeria which we have done with the support of Nigerians. Almighty God and the good people of Nigeria supported us in laying a solid foundation for the Nigeria of our dreams.”

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.