Home As e de hot Na 23 universities for naija dey give Pharmacy degree – PCN

Na 23 universities for naija dey give Pharmacy degree – PCN

207
0

Di Pharmacy Council of Nigeria don reveal say na 23 universities for naija dey do Bachelor of Pharmacy and Doctor of Pharmacy programmes.

Di Pharmacy Council yan say B.Pharm or the PharmD programmes na di smallest certificate you go get to dey practice pharmacy for naija.

Dem point out say dem dey also recognise senior pharmacy colleagues wey dia highest qualification na only Diploma of Pharmacy Certificate.

Di Chairmo for di Governing Council of the PCN, Prof. Ahmed Tijjani Mora yan for di media chat for the gazetted PCN (Establishment) Act 2022, inside Abuja say di first university wey get degree holders for naija na Obafemi Awolowo University, Ile-Ife.

Di universities wey dey give B.Pharm and PharmD programmes for di country na Kaduna State University, Kaduna State; Gombe State University, Gombe State; Delta State University, Delta State; University of Ilorin, Kwara State; Usmanu Danfodiyo University, Sokoto State; University of Port Harcourt, Rivers State; Igbinedion University, Okada, Edo State; Nnamdi Azikiwe University, Anambra State; University of Maiduguri, Borno State; Madonna University, Elele, Rivers State; Niger Delta University, Bayelsa State; University of Benin, Edo State; University of Uyo, Akwa Ibom State.

Other ones na Olabisi Onabanjo University, Ogun State; Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Osun State; University of Jos, Plateau State; University of Nigeria, Nsukka, Enugu State; Ahmadu Bello University, Zaria, Kaduna State; University of Lagos, Lagos State; University of Ibadan, Oyo State; Bayero University, Kano State; Enugu State University of Science and Technology, Enugu and the University of Calabar, Cross Rivers State.

He add say because of di new act, dem dey call PCN Pharmacy Council of Nigeria and no be Pharmacists Council of Nigeria again.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.