Di Nigerian Society of Anaesthetists (NSA) don tok say e dey very impotankpa for medication practices to dey safe so dem go reduce risk of errors and deaths wey dey happen because of drugs.
NSA been yan dis one when dem do news conference on Sunday inside Abuja as dem dey mark di 2022 World Anaesthesia Day for Oct. 16 and di tag for dis year na ‘Medication Safety’.
Di National President of NSA wey be Prof. Elizabeth Ogboli-Nwasor, point out di role wey anaesthesia dey play for global health and come beg make people dey dey careful for medication make mistake no dey wey fit lead to serious complications or to lose life.
Kalu come beg make di government make sure say light dey always dey for hospitals and make stakeholders dey do their work well.
Di World Anaesthesia Day na day wey dem dey use celebrate anaesthesiologists and di whole anesthesia community and also to tok about safe medication practices.
.
(NAN)