Home As e de hot Medication dey cause plenty death – WHO

Medication dey cause plenty death – WHO

170
0

Di World Health Organisation don beg stakeholders wey dey health make dem increase fight against problem wey dey come from medication because half of all di problem wey person fit prevent for medical care for di world dey happen because of bad medication or drugs as one quarter of that half dey dey life-threatening and very serious.

Di agency still come point out say na mostly older people dis medication palava dry affect too much especially di ones wey dey take plenty drugs.

Di WHO wey been yan dis one for World Patient Day 2022 add say dia aim na to increase understanding for di public and also motivate countries make dem promote safety for health care and this year dey put eye more for ‘Medication without Harm’.

Di global health agency come reveal say e dey very impotankpa to reduce palava wey medication dey cause and make stakeholders join hands to reduce dis problem.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.