Di Federal Government don confam say dey still stand for dia commitment to make sure say maternal and infant nutrition for di country dey upgrade.
Di Minister for State for Health, Mr. Joseph Ekumankama wey be Dr. Salma Ibrahim-Anas represent, yan dis one for Abuja on Tuesday when dem dey do carry go for di Accelerating Maternal, Infant and Young Child Nutrition project.
He yan say e pain am because día agenda just dey move slowly and government go carry more stakeholders along do dem go fit reach di goal.
Ekumankama reveal say di MIYCN wey dey 5 years now don dey work for one NGO, Alive and Thrive (A&T), and na Bill and Melinda Gates Foundation dey fund am.