Di Director General for di World Health Organisation, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don tell countries make dem keep eye to dey provide preventive health care and not to wait until people sick to treat dem.
Di WHO DG been yan dis one on Sunday when dem open di World Health Summit 2022 inside Berlin and dia theme dis year na: “Making the Choice for Health.”
Dem expect make di summit focus on di theme as dem go dey consider to tok on pressing topics like investment for health and well-being, climate change and planetary health, architecture for pandemic preparedness, digital transformation for health, food systems and health, health systems resilience and equity, and global health for peace.
Other people wey tok for di event na President of Senegal and Chairperson of the African Union, Macky Sall; Emmanuel Macron, President of the French Republic, and Chancellor of the Federal Republic of Germany, Olaf Scholz amongst others.
Adhanom still beg make countries start to dey invest seriously for preventive Healthcare.