Home As e de hot Inflation no dey let diabetes patients but drugs – Diabetes Association

Inflation no dey let diabetes patients but drugs – Diabetes Association

160
0

Di Chairmo for National Diabetes Association, Nasarawa State chapter, Mr. Umar Sadiq, don blame di high price of drugs as di thing wey dey make diabetes people no manage dia diabetes well.

Sadiq yan say diabetes people no dey fit afford di drugs and e dey affect dem well well and most of dia association members na people wey don retire wey dey manage life so dis everyday increase for goods and services for di country dey affect dem too much.

He yan say di support wey dem no get dey pull di association back and e dey make dem no call for meeting or even organising workshop for dia members.

Sadiq point out say dem get like 300 members for di state and dem don dey try make Governor Abdullahi Sule look dia side help solve some problem for dem.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.