Di World Health Organisation don give red alert to di world because of more than four cough syrups wey India make, say dem link am to di death of 66 children inside Gambia.
WHO alert warn say di syrups fit cause acute kidney injuries and 66 deaths for children.
Di Indian company, Maiden Pharmaceuticals, been manaufacture dis drugs but dem no give guarantee say e dey safe and WHO yan say di medicines na Promethazine Oral Solution, Kofexmalin Baby Cough Syrup, Makoff Baby Cough Syrup and Magrip N Cold Syrup.
Gambia been see di products for dia country and dem don mark am say nobody go distribute or sell it through informal markets or even send to other countries or regions.
Di global health agency warn say make people no dey use di four cough syrup because e fit cause injury or death especially for children.
WHO been enter di matter when medical people for Gambia been find out say kidney injury dey increase for children wey never reach 5 years for late July and di government come suspend all di paracetamol syrups, come beg make people dey use tablets.
Di WHO reveal say dem do lab analysis for di products and e confam say di syrups get amount of diethylene glycol and ethylene glycol wey dey very bad as contaminants.
Dem yan say di substances dey very toxic and effects wey dem carry dey include abdominal pain, vomiting, diarrhoea, inability to pass urine, headache, altered mental state and acute kidney injury wey fit cause death.