Home As e de hot Hypertension dey kill! Check your BP all di time! – NCS

Hypertension dey kill! Check your BP all di time! – NCS

203
0

Di Nigerian Cardiac Society don dey shout say hypertension for naija dey too much and many people wey get am no even know say dem get am as 1 inside every 10 naija person get high blood pressure.

Di NCS come yan say dem need more serious steps so dem go fit cut down how di condition dey spread because na di condition dey mostly carry heart disease and stroke come so make dem dey always check dia blood pressure because e dey kill silently.

Di Nigerian Cardiac Society been yan dis one for press release dem do wey día Presido, Prof. Augustine Odili, and dia General Secretary, Prof. Aliko Chizindu sign wey dem drop to mark di 2022 World Heart Day and dem tag am #UseHeartforeveryHeart.

Dem dey celebrate World Heart Day for every 29th September every year and dem dey do am to educate people on di palava of heart diseases and other problems e dey carry come plus different ways wey dem go fit prevent di disease for dia lifestyle.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.