Home As e de hot Health Insurance go solve naija health palava – NAMed

Health Insurance go solve naija health palava – NAMed

191
0

Di Nigerian Academy of Medicine don yan say health insurance go solve palava of poor health mata for di country.

Di new Presido for di academy, Professor Sam Ohaegbulam yan when he dey tok to journalists say dia academy don link di poor health services for naija to poor health insurance services because di country people dey always pay plenty pockets at di point when dem need health care.

Di group say with di way di political leaders for di country dey behave and di way economy dey, di government no go fit afford to give Healthcare services on dia own, so na why dem need health insurance for naija people.

Ohaegbulam wey be di chief neurosurgeon for di Memfys Hospital for Neurosurgery, yan say if person no fit pay for health insurance premium, di family members or government go help dem pay instead make dem start dey find money for surgery.

He beg make di academy find way wey go turn di public health care around for naija so dat everybody both di ones wey get money and di poor ones go fit enjoy am.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.