Home As e de hot Finance PHC make Healthcare better for naija – Ekiti State Governor

Finance PHC make Healthcare better for naija – Ekiti State Governor

113
0

Governor for Ekiti State, Dr. Kayode Fayemi don yan say Primary Health Care na di ogbonge thing wey go help to make sure say health system dey do well and that good Primary Healthcare Centre dey very necessary to reach Sustainable Development Goal three and Universal Health Coverage.

Fayemi yan this one on Wednesday for di State Health Leadership Collaborative forum inside Abuja wey dem tag “ Financing Primary Healthcare in Nigeria.”

Fayemi wey be di Chairmo for Nigeria Governors Forum reveal say di title wey dem get dey touch issue wey importamkpa to di foundation of sustainable development and di future of health for Naija.

He also point out say di right to health na fundamental human right but e hard for di country to gbam dis right for all naija people because of how our health system dey.

He yan say to help solve di palava of money for PHC care and to meet demands wey better Health system need, naija must find way to fund PHC.

He reveal say country di country go need 4 key ways so dem go do better service delivery and di ways na utilisation of di Basic Healthcare Provision Fund so dem go fit finance essential health services, especially for vulnerable people, then to improve the country’s capacity to address public health emergencies and also consolidate funding to address primary care and essential public health functions, plus to increase budgetary allocations for healthcare both at the national and State levels.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.