Home As e de hot Exercise dey help reduce Arthritis – Expert

Exercise dey help reduce Arthritis – Expert

106
0

Di Chief Executive Office for di Save Our Heritage Initiative, Ms. May Ikokwu don reveal say to dey chop better food and exercise to lose weight dey help to reduce arthritis especially for older people.

Ikokwu yan this one for interview with News Agency of Nigeria inside Abuja on Wednesday when dem dey mark 2022 World Arthritis Day.

WAD na day wey dem dey use to make people know more about arthritis, wetin dey cause am, di symptoms plus how to know on time and treat am early and na every October 12 dem dey celebrate am.

Arthritis na di big name dem dey call more than 100 rheumatic diseases like ankylosing spondylitis, gout, lupus, osteoarthritis, and rheumatoid arthritis.

Ikokwu tok say di theme dis na wey be “It’s In Your Hands, Take Action” na to raise awareness for rheumatic and musculoskeletal diseases (RMDs) and make dem inspire di people wey get am plus di ones wey dey take care of dem.

Ikokwu come point out say pharmaceutical therapeutic interventions go help di patients well well and even tho good exercise and to lose weight go help bring down di effects, pharmaceutical aid dey put eye to reduce di pain no be to remove it.

She still confam say old age dey linked to arthritis and statistic wey dey show say people wey dey more than 65 dey suffer am.

She add say even tho arthritis dey slow down movement, medicine dey advise make people wey get am dey do exercise so dem go fit reduce inflammation.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.