Home As e de hot Doctor dey court say him kpai him patient

Doctor dey court say him kpai him patient

125
0
Judges gavel and law books stacked behind

Dem don charge one medical doctor, Oyeyinka Oyetunde, to Ikeja Special Offences Court, Lagos State, say him mistakenly kpai one patient dem dey call Uchenna because him no care for am.

Di prosecuting counsel, Tola Esan, come tell court say di doc been commit di offence on June 16, 2020, for No. 1, Ajibade Oke Street, Isolo, Ikeja, Lagos.

Di prosecutor point out say di offence dey against Section 229 of the Criminal Laws of Lagos State 2015.

Di defendant come say him no dey guilty and him apply for bail.

Di defence counsel, Abayomi Omotunbora come beg make di court allow him client to continue di administrative bail wey Chief Magistrate G.O. Abayomi, of an Ebute Metta Magistrate’s Court give am.

Justice Olubunmi Abike-Fadipe come agree for di bail as long as say him go provide evidence wey dem use give am bail in seven days from Tuesday.

Di court come move di case go December 19, 2022.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.