New report don show say number of people wey get diabetes for di world go increase to 643 million by 2030, and 783 million by 2045 and most of di cases go dey happen for low- and middle-income countries like Naija.
Di report show say dis increase dey happen because of poverty, conflict, and outbreaks of disease for di areas.
Di report still reveal say lack of insulin na very big problem for di people wey get diabetes already and e come make treatment hard for most LMIC countries like Naija.
Na Access to Medicine Foundation wey be Non profit organisation for Netherlands been release dis report and dey show say cost to manage dis condition dey plenty and na big problem for di world because total health expenditure for diabetes in adults enter $966 billion in 2021.
Di report also show say na just few drug makers dey produce insulin and plenty gap still dey for di market.