One Senior Registrar of Gynaecology and Obstetrics for di Federal Medical Centre, Asaba, Dr. Samuel Illikannu don beg make women wey get belle listen to doctors to get anomaly scan because e go help di women avoid complications and incase wey di pikin go get problems, di family go know on time, come prepare.
Di health expert yan say belle dey very different for women even if she don born plenty before so di advice wey doctor dey give dey very important, make dem no dey see am like say na dia money di health officers want when dey tell dem to do di anomaly scan.
Anomaly scan as experts explain am na prenatal ultrasound wey dem dey do when belle dey between 18 and 22 weeks and e dey check di how di baby dey develop physically and even check any congenital disorders or major anatomical abnormalities.
Illikannu point out say because say every belle dey different, di woman go need do deiffernt scans as di doctor tok, even tho because some families no get money, dem dey leave di scan unless say e dey urgent.
He still come warn make families no dey ignore when doctor tell dem to do dis scan because e fit save di life of mama and pikin.
(Punch Healthwise)