Di Nigeria Medical Association don beg make Federal Government declare state of emergency for di health sector so dem go fit upgrade di sector.
Di NMA Presido, Dr. Uche Ojinmah, been yan say even tho naija don reach 62 years, di health sector dey very bad, come dey worse everyday and e follow dey cause brain drain wey dey happen for di sector.
Ojinmah come tok say make Federal Government give dem equipment and facilities wey dem go use work.
He reveal doctors wey naija dey produce since 1960 dey increase, from 100 to more than 80,000, because since di last audit wey di Medical and Dental Council of Nigeria do for 2020, dem been get 89,000 doctors and 5,000 dentists.
Di NMA Presido come pont out say doctors need good environment to work because naim dey make dem japa.
Ojinmah still twale for di country say dem dey try small small but more work still dey.
.
(Punch Healthwise)