Home As e de hot Alert don dey port borders incase Ebola enter! – FG

Alert don dey port borders incase Ebola enter! – FG

240
0

Di Federal Government don put alert for di health services wey dey all di port borders for naija as Ebola don dey deal with Uganda.

Di government yan say details for passengers wey come or pass through Uganda dey go straight to National Public Health Institute, di Nigeria Centre for Disease Control to check first.

Health people for Uganda been announce say Sudan Virus wey be variant of Ebola don land for dia country on September 20, 2022.

Di World Health Organisation reveal say di Sudan virus disease dey very serious illness wey dey affect humans and e dey kill. Dem been first find am out for Southern Sudan for June 1976 and since that time, e don dey come out, dey go as e don cause 7 outbreaks – 4 for Uganda and 3 for Sudan.

Di Ministry of Health in Uganda report say by October 2nd, Uganda don record 43 cases of Ebola and fatality count don increase to 9.

Di Director/Senior Technical Assistant to the Minister of Health, Dr. Chris Isokpunwu yan for interview say Naija never record any case at all.

.

( Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.