Academy for Health Development be di ogbonge organization for we obodo naija wey dey work to educate country pipo ontop di importankpa wey matta wey concern sexual and reproductive health and right dey, most especially abortion don graduate di first cohort of dem C4SPAA fellowship.
Di fellowship contain ten different young men and women from different career areas like journalists, social media influencers, researchers and SRHR advocates across di six region of we country.
Di fellowship wey di full meaning be Communicating Evidence for Sexual and Reproductive Health and Rights Policy and Advocacy Action (C4SPAA) was supported by the Guttmacher Institute New York, di Ogbonge organization for obodo world wey dey advocate for the need to make abortion legal because of the kain death and dangers wey women dey face because of unsafe abortion wey dem dey go to take avoid government law.
Di organisaton believe say if abortion dey legal e go helep safe lives as women and girls no go dey follow backyard to take go comot pikin wey dem no want.Di fellows include Nwangu Eudora Ogechukwu, Onwe Zack Onyebuchi, Michael Terna Adigam, Juliet Chidera Nwobodo,Ogidan Monikanola Eyitayo, Omosola Fortune Rolawe, Idoko Philip, Omokanye Christopher Oluwatosin, Oyelola Eyinade Adeoye and Akinpelu Olayemi Tosin.