Stakeholders don ask government for Cross River State make dem make budget for family planning for di state.
United Nations Population Funds’ represent, Mr. Emmanuel Emesowum, yan dis one for di third quarter meeting for di Family Planning Technical Working Group wey di Ministry of Health organise for Calabar, on Wednesday.
Di group yan say dem make di request because too much funding gap dey for di family planning implementation and stakeholders wan make all di 36 states start to dey add di family planning for dia 2023 budget allocation.
Emesowum yan say dem go share di UNFPA Family Planning Implementation Guideline for Nigeria wey dem reveal for di meeting nationwide so all di states fit increase procurement for commodities.
He tok say out of $35 million wey dem need to get commodities this year, UNFPA bring 8 million US dollars, while the Nigerian Government suppose bring di rest.
Di Family Planning Coordinator for Cross River State, Lucy Enakirerhi, urge members of thematic committees make dem create work plans wey dem go use make distribution of family planning commodities for storage facility to difficult-to-reach villages and centres we need intervention easier.
Agencies wey dey partner with dem like agencies World Health Organization, Ministry of International Development Corporation, Cross River State Budget Office, and NGOs plus other come give día goodwill messages for di event.