Di World Health Organisation been reveal on Tuesday say dementia na di 7th highest thing wey dey cause death for people for di world but still di research dey less than 1.5 percent for total health research output.
Dementia na syndrome wey be when person memory don dey fade and e no fit think straight or remember things well especially as di person dey old.
WHO point out say more than 55 million people dey live with dementia for di world and almost 10million new cases dey drop every year.
WHO yan say dem need ways wey dem go fit understand, prevent, and treat di main small diseases wey dey cause dementia and also still provide care and support for people wey get dementia.