Home As e de hot You fit still get belle as you dey breastfeed! – Expert

You fit still get belle as you dey breastfeed! – Expert

213
0

Health expert wey be Dr. Damian Avar don beg mama dem wey dey give día pikin breast to make sure say dem follow family planning method even tho say tok dey show say exclusive breastfeeding no dey let dem get belle immediately after dem born.

Di physician yan say e dey very possible to carry belle just 4 weeks after dem born, even tho say na exclusive breastfeeding dem dey do.

One article wey dey for verywell.com wey be health education site tok say e fit take few weeks, few months or even longer for woman body to dey fertile again after she don born.

Di article still point out say na 6 weeks e go take di woman body to heal after e do natural birth and if di woman no give her pikin breast, e fit take that same 6 weeks for her period to come back.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.