Home As e de hot We wan set up blood banks for Anambra! – Commissioner

We wan set up blood banks for Anambra! – Commissioner

186
0

Di Anambra Government don reveal say dem get plans to set up good blood Bank wey dey function well for three senatorial districts so e go fit reduce maternal and perinatal death for di state.

Di Commissioner for Health wey be Dr. Afam Obidike yan dis one on Tuesday when dem do meeting on Maternal and Perinatal Child Deaths Surveillance Response inside Awka.

Obidike tok say dem don notice say di postpartum haemorrhage or severe bleeding wey dey happen during and after childbirth be di major cause for maternal mortality for di state and dis blood bank wey dem wan set up go help to reduce maternal death wey dey happen because of haemorrhage.

He reveal say e pain am say women wey dey deliver dey kpai from something wey dem fit prevent with timely, effective maternal care management especially for rural areas.

Di Commissioner come still describe one anti-shock garment wey be stretchy wrap wey dey apply pressure for her lower body and abdomen and e go help stabilise woman from postpartum haemorrhage.

Obidike yan say di state government don set up blood bank for Onitsha General Hospital and dem dey plan set up more inside those villages wey get very high mortality rate.

Di Coordinator, of Reproductive Health, Dr. Uju Okoye, for her own side yan say if dem do di solutions wey dem agree for di meeting, e go help maternal health well.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.