Home As e de hot We wan get di same database of informate – African Agencies

We wan get di same database of informate – African Agencies

252
0

Some African Drug and Food regulatory agencies come together inside Abuja to crack brain on how dem go dey work with di same line of information and record for Africa.

Na di African Union Development Agency (AUDA-NEPAD) been collabo with Nigeria National Agency for Food and Drug Administration and Control organise dis event wey start on Monday.

News Agency of Nigeria come carry report say dem been dey tok about rules and details dem go put for COVID-19 vaccines and other health mata for Africa so dem go get Smart, Safety, and Surveillance (AU-3S) for all di products dem don set.

NAFDAC Director-General, Prof Moji Adeyeye come open up say di AU-3S don become small agency wey dem go dey depend on for informate for each country and di agency don already dey share informate for countries wey dey Africa like anti-retroviral, anti-tuberculosis, and anti-malaria, as dem don set up NAFDAC work for di AU-3S.

Adeyeye come still add say di agency no go dey monitor just food and drugs but even distribution for products generally.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.