Di Medical Director wey dey Federal Medical Centre, Bida for Niger State, Dr. Usman Abubakar don deny say dem increase money for health mata for dia hospital and money people dey pay to see doctor for consultation na N500, no be N3000 wey some people dey talk.
Abubakar tok say women wey get belle wey dey come for antenatal dey pay N1000 for card so dem go keep día record and dem no go pay anything again for another belle.
He also tok say di women dey pay another N1000 for things wey dem dey use like detergent and some things to chop.
Abubakar come still tok say dem dey provide quality healthcare service to día patients for that community and even di state and dem dey do well.
Di Medical Director come still point out say any small money dem been add on top na just because things wey dem dey use work don cost because economy no balance but nobody dey charge N3000 for consultation or antenatal for dia hospital and also make people dey verify informate before dem go run go social media.
He still add say him door dey very open if people get complain and to verify any informate wey anybody hear about the hospital and people still fit check día website wey be “www.fmc.org” to get día contact or di Service Delivery Unit (SERVICOM) for any complain dem get.