Home As e de hot We no go strike for now – Resident Doctors

We no go strike for now – Resident Doctors

183
0

Di National Association for Resident Doctors don reveal say dem don calm down for di strike wey dem dey plan as dey wan continue to dey tok with Federal Government and stakeholders to make dem understand dia demands.

Di Presido for di association, Dr. Dare Ishaya tok say na on Webesday dem been decide when dem dey do dia extraordinary National Executive Council meeting.

Ishaya, add say dia association go continue to dey tok with all di right people till dem sort out all di matter dem get peacefully and dem go release statement on dat one soon.

NAN dey report say di association don dey give government notice since make dem start to dey pay di Hazard Allowance and arrears wey dem agree since December 22, 2021.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.